Wednesday 29 April 2015

Professor Tamuno David-West Wants to be theMinister of Petroleum

 Professor Tamuno David-West wen be Minister of Petroleum (1984-1985) under the Soja government of Oga Muhammad Buhari don come out beat him chest with confidence to tell Nigerians say "OGA MUHAMMAD BUHARI GO REDUCE THE PRICE OF FUEL TO ‪#‎4O‬ PER LITRE"

The Oga of the join-body of people wen dey sell petrol for Ogun state Oga Adeleke Bada, sef don carry mouth confirm am.


Some people don come out to agree with the two of them 100 % but others talk say make Oga Tamuno David West & Oga Adeleke Bada hold brake for this kain talk because e fit put confusion for the mind of plenty Nigerians as dem go dey feel say Oga Buhari go do ABRACADABRA and petrol price go just fall yakata like that.


Abeg put mouth for this matter: THIS #40 PER LITRE NA PACKAGED PROMISE TO GIVE ORDINARY MAN HOPE ABI E POSSIBLE?

Biko, talk your own put for the matter now make the full Nigeria hear you & share!! ‪#‎ASEDEYHOT‬ @wazobiatvng (Channel 195: Startimes -- 10am - 11am) @ezugwucc @nkubiwzb


No comments:

Post a Comment

A MUST READ

BEHIND THE OPOTO FESTIVAL

The production of this painting is to enable the society to know and understand the positive effects and the needs the Opoto festival in Enu...